Post by Cruzita (@Cruzita)
AWEARNESSπ₯π₯π₯πππ
Una Good morning π π
A lot of people have been asking, why is that on Lekeelekee app... people who have 1k followers get little engagement even when they are frequently posting?
Now the thing be say, Lekeelekee na new app wey them open February 2026, and as of then when they lunch am for Arise Tv, alot of people rush open am ,gather followers and disappear..that's why when you check some account, it will show their last post 7Months ago ...
So Lekeelekee no be like Instagram where if you get 1k followers, 1k people go see your post. For Lekeelekee na different system.
*Why e dey happen:*
*1. Your 1k followers no dey active.*
Many people download the app that time when dem launch am for February, dem follow 100 people then dem no open app again. So inside that 1k, na maybe 50 or 100 people na e dey really active.
*2. Na interaction dem dey count, no be how many times you post.*
The app dey check:
- How new your post be
- How many people like/comment your post before (engagement rate)
- Whether that person don like you before
If you dey post 5 times daily but nobody dey like am, the app go think say your post no sweet π, e go stop to show people.
*3. Everybody na seller, nobody be buyer.*
For now, everybody come Lekeelekee to post their own content, nobody wan comment for other person own, that's why u need to create your community...so many senior creators have talked about creating community..Go to their page and learn ..
*Wetin you need to do:*πππ
- No dey post 5 times a day, post 1 or 2 quality posts with questions or polls.
- Go comment genuinely for other people's posts
- no just put "nice". If you comment for dem, dem go see your own too.
- Join Groups for your niche, na there real engagement dey for now, no be for homepage...If you get any group wey you know add me abeg ...ππππππ
- Post video or voice note, na that one the app dey push pass plus post with picture...
Na new app, e go still grow. No tire!!!πππ
Let's keep hope alive ..the good thing be say e dey pay ...
Today is our Day 10
Approaching 800 soon...
#LekeeLekee #Trending #Viral #CFC #Nigeria #LekeeLekeeFamily #NaijaPride #Sports
0 likes Β· 0 comments Β· 0 shares