Post by Joy&raph (@joyunique)
This thing the bother me since three days now, nain I say make I carry come here make we reason am together as colleagues wey we be.
You see those two screenshots wey dey down there? Nain I wan use show una as example make e no be like say I no know watin I the talk or my phone no good.
E get some people for here wey I the always see them the engage for my content, if I say make I go check their side, as I click their profile na watin go show be this, e no the load make I fit comment and e the pain me no be small.
I no just know watin the cause this thing. No be say I no get data o I get but na so e the always show, even if I close the app come back na the same thingπ
Abeg who the experience this thing too make una tell me watin I need to doπ€
#lekeelekee #lekeelekeefamily #complain #joy&raph

0 likes Β· 0 comments Β· 0 shares