Post by Cruzita (@Cruzita)
WAIT O! π So some of una think say CONSISTENCY na to dey login everyday for Lekeelekee app? Ehhhh my fellow newbies! ππ
Okay oooo, my own na to show workings. If you like hear, if you like read! π
As Bible talk also say: "Make it plain on paper, so he that runs may read it:::
So I dey write am now ooo, still dey make am plainπ...
*Oya definition of CONSISTENCY from CRUZITA π*
Consistency no be say you come online everyday for Lekeelekee show face say "I don login". Mba ooo! That one na eye service!ππ€£
Consistency na:
π To dey build community for yourself
π To dey comment for people post genuinely
π To dey repost other people work
π To comot your mind like me from that Lekeelekee money firstππ€£π
π To make people remember you for wetin you dey post
π To dey follow people even when them never follow you back
Abeg, how best our senior creators wan take explain again give us?π€·π€·
If you go offline for 1 week now, wetin I wan take remember your page? Wetin be your content? My fellow newbies, tell me na?π€¦π€¦
Abeg SHOW WORKINGS biko! Make I fit waka enter una comment section go check wetin una page dey do.
I no dey force anybody ooo, as I dey learn, I dey show us road. Read to learn. Make nobody later come ask me "how you take grow?" because I dey drop feedback of wetin work for ME!
No worry, you fit thank me later! π
We are moving to 800 soon..ππππ
#Viral #Trending #LekeeLekee #LekeeLekee #LekeeLekeeFamily

0 likes Β· 0 comments Β· 0 shares
Comments
Consistency no be login-login every day like sey you dey clock attendance for office. That one na just eye service as you talk.
Real consistency na:
You dey show face with value
You dey engage people genuine
Your page get identity
Even if you disappear for one we...