Post by Cruzita (@Cruzita)
Una happy Sunday oooo, so some of you no go church ehhh..πππ
*WAIT, YOU DEY THIS COMMUNITY, YOU NO DEY FOLLOW CREATORS?*π±π±π±
Make I ask you... wetin you come dey do for here then? π
π
π
π
And you dey follow creators, but you no dey learn anything from them β you no dey read their tips, you no dey watch how dem dey post. My fellow newbies, wetin you come dey do ehhhh? π€·π½ββοΈπππππ
Me I go talk truth β *na senior creators push me reach where I dey today o!*π
Their encouragement, their advice, their ginger... na e make me grow from Day 1 to Day 9 like this. I no dey hide am.
Check most of my posts, I dey tag them there. Because I appreciate them π―πππππ
My own advice for una be this:
*Oya go follow these people NOW if you never follow them:*
1. The CO-FOUNDER
2. The LEKEELEKEE UPDATES PAGE
3. The LEKEELEKEE MODERATORS
4. And those senior creators wey dey always drop value.
Make you dey get first-hand info, make you no go miss update. No be every time you go dey complain say "your post no show, your engagement low" β you no follow who know road, how you wan know road?πππ
You know say I no dey hide update abi? Anything wey work for me, I must share am.π
Follow who know road, make you grow fast!
Day 9 still counting.......e remain small to reach 700...π€Έπ€Έπ€Έ
*WE MOVE! π*
#LekeeLekee #Trending #Viral #Nigeria #Nigeria #LekeeLekeeFamily
0 likes Β· 0 comments Β· 0 shares
Comments
Pls am. Having running stomach
Don't put me for heavy laugh to mess up my body
Thank you boss for reposting