Post by Cruzita (@Cruzita)

*MAKE UNA WAIT FIRST, I WAN TALK SOMETHING! πŸ˜‚*
Carry chair comeπŸ€£πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡

As a newbie for this LekeeLekee community, I promise say anything wey work for me or wetin I notice, I go share am. So make una carry chair come... 🀣

I don see some people dey complain for here say β€” Their post no dey get engagement"...some say their post no dey show at all, e be like nobody dey see am and their comment for comment section dey disappear 😏😏😏...

Omo, na 2 things dey cause am oo, and I don notice am:πŸ‘ŒπŸ‘ŒπŸ‘ŒπŸ‘Œ

*NUMBER 1: KNOW YOUR POSTING TIME!*
Every creator gets his/her own time wey him people dey online. You gats know your own algorithm. People no go dey online 24hrs dey wait for your post na β€” everybody get work! πŸ˜‚

Some of you go post by 11:00PM for night come dey expect 100 likes, knowing fully well say people don sleep. Yes, we get night crawlers, but no be everybody be night crawler nah.πŸ˜‚πŸ€£πŸ€£

Try post for morning 7am-9am, afternoon 12pm-2pm, and evening 6pm-9pm. Na that time people dey press phone pass u get ?

*NUMBER 2: STOP THAT COPY AND PASTE!*
This one na the major one. See ehn, if you copy person post word-for-word come paste for your page, LekeeLekee new moderator go flag am as DUPLICATE CONTENT. Your post go just disappear, no engagement, no like, nothing. You go come dey wonder wetin happen.πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ€£πŸ€£
And if your page still be NEW PAGE like my own β€” aswear, OTILO! πŸ˜… The moderation for here don dey very strict, dem no dey joke with duplicate content because dem wan protect us from spam.

So abeg, add your own voice. Even if you wan share job or news, rewrite am with your own understanding.

I don talk finish! 😊

Remember today na Day 8, shey we fit reach 700 today like this? Oya follow who know road, make we grow together!

WE MOVE! πŸš€
#LekeeLekee #Trending #Viral #CFC #Nigeria #NaijaPride #LekeeLekeeFamily #Sports #News

*MAKE UNA WAIT FIRST, I WAN TALK SOMETHING! πŸ˜‚*
Carry chair comeπŸ€£πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡

As a newbie for this...

0 likes Β· 0 comments Β· 0 shares

Comments

Ozioma Okafor: You said it all right. No app allows photocopying of people's work word for work
Delanxi: Happy Saturday love 😘 enjoy your day
marvelous: well said thanks for this
Miss Annabel Ossai: You just give them the secret🀭 is left for the wise to learn
Thank you so much
Mosiko Esther: Mama thank you for this ooo,I don take note oo, especially that time to post ooo..
Cruzita: @bouqui
Thanks for reposting ..I see ya...

But why not post with caption ehhhh...
Where we won comment give you now...
So the post wey u repost nah my comment e go come ...

I been don talk about this nah...
Ekwem Patricia: Well done.
Ani Deborah: Thank you so much for always showing us the way
Daniels Nwamaka Deborah: Thanks for this information
Jennifer Ogechi Agu: Yea we fit reach 700, thanks for this