Post by Cruzita (@Cruzita)
This one wey una dey ask me for my scope... I no do anything much ooo ๐
Na just CONSISTENCY. Commenting, reacting, following others too, and making sure my page no empty. I no ghost my own page oooo..like some of us no post anything for us to read or watch....๐๐๐๐
I don talk about the scope already na... just scroll down my page, you go see am there ๐ Read am well and follow the prompt.
*Note: CONSISTENCY IS THE ONLY KEY!*
And again, some of us newbies go post something come go relax without replying comments. Ehhh! Don't you know that replying comments gives you more visibility? E dey send notifications wey go pop up for other people page, e dey show algorithm say your page dey active!
Make una learn ooo, I still dey learn too.
Anything wey work for me, I go definitely give una update. But after the update, you go get strength to execute am? You know as e be na โ you fit carry horse go river, but you no fit force am drink water....so do the needful...
So buckle up my fellow newbies, no dulling!
Today na Day 7 and we still dey count... WE MOVE! ๐
CLEAR ROAD TO 700!
#CruzitaArmy #LekeeLekeeTips #ConsistencyIsKey #NewbieToNewbie
#Trending #Viral #LekeeLekee #LekeeLekeeFamily #CFC #Sports
0 likes ยท 0 comments ยท 0 shares
Comments
I believe consistency is the key
As I don follow you make you sef follow back please