Post by Joy&raph (@joyunique)

Let me say this once and for all

You see some of una wey go see person engagement for una page or profile over and over and still do like say una no see am or come the person page come just like comot, I just sit down the watch una with one eye.
This engagement thing wey we the talk about no be say watin you post make sense but sometimes person just wan show face for you make e fit push and count for you but una the see am like say una the entitled to the engagement wey person the give you.

The people wey the manage this app say e get some engagement wey no the count but some of una just get coconut head.

Una go still come person page or profile still make that kind comment, e no make sense at all.
All of us here na adult and everybody for here want grow, even if na just fun you come here for.

To some of una wey the form celebrity abi watin I go call am I just the watch una and I want make una know say me sef na celebrity for my husband houseπŸ˜‚( if I no add husband matter e no go sweet me)

Make we try make this place a better place for ourselves and the developers.

We rise by lifting othersπŸ’―
If you never follow me you fit do am now make we all help each other grow.
#lekeelekee #trending#joy&raph #communityprogress #viral

Let me say this once and for all
 
You see some of una wey go see person engagement for una page or...

0 likes Β· 0 comments Β· 0 shares

Comments

Ivy's corner: No mind them,nah pride they worry them...@joyunique
Danjuma Augustine: As all of una don agree to wetin she said, who go come plead guilty to the complain nw.
Well, make I apologize on ur behalf.
Mama we dey sorry, abeg no vex. We go do better.
Joy&raph: @plotwithtundun you na my G if I see watin you do wey I no like my sis I go come your Dm na so my own beπŸ˜„
Ivy's corner: No mind them,pride go choke them soon πŸ˜…πŸ€£πŸ˜‚πŸ˜‚
Plot with Tundun: Hope no be me you dey follow talk sha 🀣🀣 cause i don't trust you and by the way must you pepper the singles πŸ˜’πŸ™„
Eunice: I too love you πŸ˜‚
Adebukola Adenike: Una press p totally oo. But then, you are right
Victory Amarachi: What kind of engagement does not count?
Ogochukwu πŸ’œ: We rise by lifting others
Word πŸ‘
Oluwatoba Omolara Oyewumi: You are looking I love this information we need to do better quick quick