Post by NaijaChoice News (@Naijachoice)
This person wey you dey see here na referee, no be say e dey chat hin w!fe for WhatsApp oo, no be say e dey check hin ticket oo.
E dey try give person yellow card and di thing bin happen for Uruguay during Nacional vs Rentistas wey shele yesterday.
Dem dey call am digital/virtual card and Uruguayan league board dey test am make dem see whether dem go leave normal card dey use this digital one.
This one no dey carry battery, if referee won give person card e get where e go press yellow card or red card go show, e get where e go write di players name also.
Many people say make dem leave this one make we dey use our normal card while some people say dem want am.
My people how you see this one ?

0 likes · 0 comments · 0 shares