Post by NaijaChoice News (@Naijachoice)
Roberto Mancini wey be former Man City coach don come out tok say anything wey dey happen for Man City currently no concern am say na Man City business be that one.
Oga Roberto bin tok this one during hin press conference wey e do yesterday.
Incase you no know, report allege say when Man City employ Oga Mancini in 2009, Man City write for paper say Mancini dey collect €1.69m every year for di club.
Another update show say Oga Mancini dey collect €2m every year for Al Jazira FC and according to dem baba dey work as football consultancy for di club.
Na di same person wey get Man City get Al Jazira FC but wetin dey suprise people be say for Man City, baba dey work full year dey collect €1.69m but for Al Jazira baba dey work 4 times per year dey collect €2m asin e go advise di club 4 times in year collect €2m.
Since na di same person get di two clubs dem believe say na hin Man City salary baba dey collect like that but Man City use style to avoid FFP wahala, allegedly ooo.
So one journalist ask Mancini about di matter yesterday baba say nothing concern am say Man City no dey guilty oo but di matter no concern am say that one na Man City business😂
My people abeg wetin Mancini tok e good ?

0 likes · 0 comments · 0 shares