Post by Benita Dera (@pretty_benita3)
PROSTATE ENLARGEMENT (BPH) vs PROSTATITIS
**PROSTATE ENLARGEMENT (BPH)
**Wetin be am?** Prostate dey BIG pass normal, dey press urine pipe Prostate dey SWELL with or without infection
**Who e dey catch?** **Papa dem — 50 years and above**. As man dey old, prostate dey grow naturally
**Nature** **NOT cancer**, na benign growth — e dey grow slowly for years ** e fit come suddenly sharp-sharp
**Main Cause** Age + hormones (testosterone), family history Bacteria (UTI, STI), prostatitis, sitting too long, holding urine, stress, pelvic muscle tight
Symptoms** - Frequent peeing, especially night
- Weak stream, e dey start slow
- You feel like bladder never empty
- You dey push - Burning pee like pepper
- Frequent peeing too,
- Urine fit cloudy/blood
- Ejaculation fit reduce small, **Painful ejaculation** — na why men dey fear sex
**Danger?**
If you leave am, e fit block urine, damage kidney Acute type fit enter blood (sepsis)
- *Prostatitis = inflammation of prostate,
Who go fit get am- young men from 20yrs and above, causes,infections like gonorrhea, Chlamydia, tight nylon boxer, lifestyle like too much alcohol, tramadol, smoking etc
> *Both NO BE PROSTATE CANCER!* But if you see blood for urine, very weak stream, weight loss, back bone pain — go hospital quickly to rule out cancer (PSA test).
> . Early check dey prevent kidney damage!
>
> Tag your papa & your brother — this one fit save life!
> #MensHealthNaija #ProstateHealth #BPHvsProstatitis #LekeeLekee

0 likes · 0 comments · 0 shares
Comments
Prostate no dey wait for old age to start — e dey start to grow since you be small boy, but problem go start later.
*Breakdown by age — how e dey happen:*
*From Birth to 20 years:* Prostate small like groundnut — e dey grow slowly with puberty.
*Age 25...
I hope we can have more of it this simpler way
What do you suggest to do immediately?
It's well
Thank you for sharing ma
This is for you