Post by NaijaChoice News (@Naijachoice)

Una don dey carry this una data analysts work dey go far ๐Ÿ˜‚

My people, these people wey you dey see here no be people wey police dey parade oo, no be people wey collect money to come cry for bur!al ooo, na footballers be this oo and na cry dem dey cry so o.

Di club wey these players dey play for na Club Guabirรก of Bolivia and wetin happen be say dem dey explain wetin make dem chop 6-0 against Always Ready yesterday.

According to dem, dem say no be their fault oo, say some mafia boss bin threaten dem say if dem no chop goals like that say dem go kpai dem and their family.

Di goalkeeper say dem tell am say if e no chop 3 goals for first say dem go kpai hin mama naso di werey take chop 5 for first half o( ebi like baba add jara for dem incase 3 no reach dem )๐Ÿ˜‚

Club Guabirรก players and their coach don come out say make people come help dem oo, make dem fit dey enjoy their football in peace.

Although, we no know whether dem won cover di 6-0 wey dem chop abi na true true say people threaten dem.

My people shey you believe say dem threaten dem?๐Ÿ˜‚

Una don dey carry this una data analysts work dey go far ๐Ÿ˜‚

My people, these people wey you dey see...

0 likes ยท 0 comments ยท 0 shares