Post by Miebaka Emmanuel Ikiriko (@miebaka86)
β¦962 BILLION FOR MOTOR AND "EMPOWERMENT" WHO SEND US MESSAGE? ππ₯
BudgIT no talk, Tracka don drop am. 2026 budget dey show us shege:
π β¦15.13 Billion β 39 SUVs (One motor = β¦388 MILLION. Oga, your village house + your papa land + your mama shop no reach that price. But no wam.)
π¦ β¦947.7 Billion β 2,579 "Empowerment" Projects (We sabi the film. Na audio empowerment. Stomach infrastructure. "Youth" wey no see shishi. By 2027, nobody go remember.)
But wait first , this ONE BUDGET LINE FAT PASS 7 FULL MINISTRIES COMBINED!
Seven. Whole. Ministries. One car and empowerment budget.
Hospital dey use candle. Fuel dey do yoyo. Insecurity dey chop us raw.
But priority? V8 engine and empowerment wey no empower anybody.
Na who do us? Na we do ourselves. πΆββοΈπΆββοΈ
E pain you? E suppose pain you. Share am make e pain another person too. π

0 likes Β· 0 comments Β· 0 shares