Post by Student_Nurse Eno Wellington (@eno_wellington)

One hard truth hit me this morning...

As a human wey dey hustle and work hard, pray make you succeed.
Pray ooo. Make results show because if e end say you fail, no matter how hard you try, people no go believe say you try. Dem go just say you lazy.

Even your closest people fit tell you say your best no dey enough, even when dem see say the last thing wey remain for you to give na your life in the course of the struggle.

Pray o... pray well make you succeed.
Good morning, family. ❤️

#LekeeLekee #SuccessMindset

One hard truth hit me this morning...

As a human wey dey hustle and work hard, pray make you succee...

0 likes · 0 comments · 0 shares

Comments

Rejoice Obiageri Ibe: E go show oh!
Gladden Ngozi: Exactly, na your result makes the difference.
If result no show , nobody go know say you try.
God no go shame us