Post by Eneojo Sani (@ESANI2091)
Your self appointed class monitor is here again!
To remind us of what they called "Historical Guilt" 🔥
We dey shout “Colonial masters!”
Yet na we dey sell our own people's destiny like pure water for traffic.
We curse imperialism with one mouth,
With the other mouth we dey open border for new masters wey bring dollar...
To destroy our industries first,
and now our farms.
We allow dem to make our youths unemployed and unemployable...
only to turn around to insult us as "Lazy"
As long as we dey push their agenda,
As long as we dey betray our people for contract and position,
No be dem dey colonize us again...
Na we dey renew the lease!
No man wey get hand for soiling our soil with blood of our people...will escape the judgment to come.
Historical guilt no dey for the colonial demons alone,
We too go collect our own fair share....
Because history never forgets...
and We will remember...
AND We no dey carry last.
NO! NO! nO! We never dey carry last.
#WeMove #YasukeProject #SPECProject #LekeeLekee
0 likes · 0 comments · 1 shares
Comments
— Romans 12:21