Post by Eneojo Sani (@ESANI2091)
Today's Epistle!
Yasuke rise from chains to become a nobility
without any "victim mentality" or excuses.
No shouting of "egbami oh"
“dem enslave me o!”
No dey blame colonialism every day.
The man pick up sword, fight with blood and steel, and earn im place among legends in history!
If Yasuke, one single African pikin wey dem carry as slave, fit do am,
Then we children of the great warriors, empire builders, and great kings,
...we no get excuse!
Make him life be our indictment.
Make him loyalty be our mirror.
Africa, wake up!
No more story wey dey end for suffering.
The man wey vanish hundreds of years ago still dey speak with thunder.
Rise!
No be by mouth.
Rise by action.
Rise by character.
Rise by fire!
#YasukeProject #WeMove #SPECProject #LekeeLekee
0 likes · 0 comments · 0 shares