Post by Eneojo Sani (@ESANI2091)

Your self appointed class monitor is here again!

Something don dey vex me!
People wey insecurity, inflation, unemployment and many things dey disturb still get time dey carry ofofo around!
Are you normal? abi dem borrow your brain go play Baba Ijebu?
if Yasuke dey get time for ofofo, him for forget to develop character wey announce am when time reach, same way like Joseph for Bible
But the man shock the whole Japan turning from a slave into a royalty!
He no beg for seat.
He earn am with character, with sweat, with chest!
From chains to legend. From nobody to warrior wey kings dey fear.
My African brothers and sisters, hear me well:
Your worth no dey for your lowest moment!
No be when dem enslave you,
No be when poverty slap you like area boys,
No be when dem call you useless.
Your worth dey inside your lion self, wey go wake when the chain break!
Yasuke show us say character na the real crown.
No be colour, no be tribe, no be where you start.
Na how you stand when dem expect you to kneel.
Na how you fight when dem say surrender.
Them take Yasuke as slave,
But character turn am to legend.
#YasukeProject no be just history o.
Na our spirit wey dem fit chain but no fit kill!
We remember our blood.
We remember our fire.
We are not defined by our falling.
We are defined by how we rise like okada wey refuse to stop for police!
We remember.
We rise.
We Move.
The African lion no dey born to beg.
Character go always announce us!

#YasukeProject #WeMove #SPECProject #LekeeLekee

Your self appointed class monitor is here again! 

Something don dey vex me!
People wey insecurity,...

0 likes · 0 comments · 0 shares