Post by Eneojo Sani (@ESANI2091)
Your self appointed class monitor is here again!
The school time keeper don ring bell for assembly!
Because the level we reach so!
Na only unity be the way forward
My people, from now on, make we dey talk like people wey blood dey reach dem brain!
We dey fight ourselves like area boys over 10K change wey Alaye drop,
Yoruba vs Igbo, North vs South, Christian vs Muslim,
While the real enemy dey laugh and chop our future like suya.
Na who benefit when we dey scatter?
Na who dey smile when we dey divide?
Abeg, enough!
We be one blood, one sweat, one suffering.
Our mothers dey cry the same cry,
Our youths dey hustle the same hustle,
Our children deserve better than this tribal nonsense.
Let us braid our destiny like correct Yoruba hair,
Let us stand together like Aboki okada riders for go-slow, unbreakable!
One Nigeria, not by force, but by choice.
One voice, one fight, one future.
No more “them” and “us.”
Na WE!
From Lagos to Kano, Enugu to Maiduguri,
Let love overcome hate, let unity swallow division.
Together we go strong pass any government,
Together we go build the Naija wey we dey dream.
Rise!
Unite!
Move!
Even lions dem dey hunt in packs
Na when we gather, the jungle go fear us.
#YasukeProject #WeMove #SPECProject #LekeeLekee
0 likes · 0 comments · 0 shares