Post by Eneojo Sani (@ESANI2091)

Your self appointed class monitor is here again!
No More Talk Without Work πŸ”₯
From today, new law don drop!
You go only fit complain about Naija...
Only if you get your own solution wey go solve am.

You wan to curse government?
You better have a suggestion on how you go do am better!
No more β€œNaija don finish!” without β€œHow we go unfiniish am!”
No more pure criticism like say na fuel wey no get engine.
You wan shout?
Add solution inside the shout!
Complaint without solution na just noise for market.
Na gossip wey dey wear agbada.
Na mumu wey dey do press conference.
If you no get solution, na just fear you wan market be that!
And join those wey dey find solution today!
We no dey need more lamentation generals.
We need solution soldiers!
Criticize with sense or commot for road!

#YasukeProject #WeMove #SPECProject #LekeeLekee

Your self appointed class monitor is here again! 
No More Talk Without Work πŸ”₯
From today, new law d...

0 likes Β· 0 comments Β· 0 shares

Comments

Danny Angbashim: Yeah, this presumes that those on the driving seat are hearing.
And beyond hearing are also humble and willing enough to listen.
And are not so self opinionated as to shoot down every alternative viewpoint.