Post by Eneojo Sani (@ESANI2091)
Today's epistle...
Wake up, O Africa!
No more dulling for Sahel!
Because the Ancient drums dey beat,
And the sound don swell pass Ijebu garri!
The Captain don light fire for desert
Come scatter the darkness wey dey cover us!
Why we dey wait for crumbs from oyinbo's table,
While our own riches dey leak like rusted Government water corporation pipes wey dey abandon?
Abeg, cast away that vulture mentality,
Make the Lion wey dey inside you wake up to roar!
Vulture dey beg for leftover, No strength, no shame, just plenty empty boast.
But Traoré don show us say fire still dey burn inside us all!
and Sovereignty na seed wey we must plant and grow, to take by will.
No more begging, no more “abeg oga”, No more crumbs from colonial master...and enough to the "Yes Sir Boys" grooving.
The hunt belongs to those wey get mind!
Arise, Great Lions! of Africa and Reclaim your throne!
This na your land, your time, your own!
and then we move
Because when #WeMove with the #YasukeProject 's spirit, #SPECProject will naturally produce the structure!
0 likes · 0 comments · 0 shares