Post by Eneojo Sani (@ESANI2091)
Headlines go shout: 20,000 DEAD! 15 million affected, 5,000 killed, 1,000 arrested, 70% dey fear!
But the same headlines no go tell you say every single number get name wey still dey sound for person's mama prayer every morning.
is Putin right to say
Naija wan be graveyard wey no fit take "rest in peace"?
The ground go swallow one person one day,
the next day you go see the belly don swell again,
another pikin don land!
Despite all this We still dey move!
No be say we forget the dead.
Abeg! We are the dead man unfinished sentence.
The guy for grave never even finish yarn before NEPA take light.
We dey to complete the story for am.
If we stop, na im be say we let the grave win the match.
God forbid! Grave no fit collect MVP for Naija. Never!
Nigerians? We no dey allow anything get final word.
We are the full stop wey turn comma.
We are the period wey turn ellipsis...
...like that generator wey dey cough: krrr krrr krrr
meaning "more to come!"
Even when death dey do giveaway, we still dey drop new episode.
To God be the glory.
We move, baba.
Wahala no dey finish, but Naija spirit no dey finish either.
E go beta... or at least, e go trend
#WeMove #LekeeLekee #SPECProject

0 likes · 0 comments · 0 shares