Post by Eneojo Sani (@ESANI2091)
When Africa still dey fight each other like area boys for bus stop,
While the real Enemy dey laugh from afar, chopping our resources like suya.
One brother dey chase another with machete because of border wey dem draw with colonial pen,
Xenophobia dey burn shops in South Africa,
Our youths dey drown for Libya sea,
While big powers dey still divide and rule us like say na their grandfather land.
Na who be the real Enemy?
Na poverty wey dem export come give us?
Na debt wey dey choke us like oversize agbada?
Na the system wey scatter us into 54 small-small countries dey shout “sovereignty” while dem dey loot together?
Abeg, make we stop this family fight!
Zelophobia, tribalism, “my country better pass your own”
The Enemy no dey send you message, e dey use our own hand slap us.
#WeMove #LekeeLekee #SPECProject
0 likes · 0 comments · 0 shares