Post by Eneojo Sani (@ESANI2091)
Naija Summary with Pepper... The Luck of Relationship
To survive No be by power alone o!
Na "my guyman wey know person wey know person" dey run this country!
Na that neighbor wey dey watch your pikin when you dey on a bread quest,
That friend wey go send you alert without you begging,
That "how far?" wey turn to transport fare.
Na the "Partnering" thing, that becomes our collective destiny wey braid fortune like good Yoruba hair.
You lift me, I lift you. Today na your own, tomorrow na my turn.
We share the little we get because we know say candle wey come together fit fight darkness.
We give without counting change, because life na wheel, e go turn.
Your people na your real luck.
No be by solo flight, na by collective hustle and grace!
Na we be each other’s loading!
Because on a circular planet, there is no permanent up-side-down!
#WeMove #YasukeProject #SPECProject
0 likes · 0 comments · 0 shares