Post by Eneojo Sani (@ESANI2091)
NAIJA HEADLINES DEY SCREAM, AND WE DEY ROAR BACK!
News land this morning like wicked area boys.
Armed men sack two villages for Niger State, carry 20 souls.
Kebbi side even worse with 47 bodies, and 500 dey run.
1,400+ killed, 1,800 abducted since January.
US dey shout “Do Not Travel” for 23 states like say Naija na Iran wey dem bombed.
Inflation dey choke person, 150 million for hardship,
Poverty dey add 10,000 people every single day.
Petrol, food stuffs, light bill all dey carry people do press-up.
Yet you may ask how we still dey stand?
But Do not mistake our laughter for mumu.
As we dey always adjust like tailor wey no get cloth so
Na architecture wey go show when jungle soon mature!
For now!
From graves of Shiroro to ashes for Jilli Market,
We still excavate hope with our bare hands.
Headlines go shout tomorrow, prices dey climb like bolon-bolon wey escape,
But we go rise, hustle, laugh, and move.
#WeMove
0 likes · 0 comments · 0 shares