Post by Okediadi Emeka (@emekoked)
Bot Pita tel Jisos,"Tel us wetin yu min." Jisos ansa,"Afta evritin wey I don tok so, una nor stil undastand? "Una nor no sey enitin wey pesin chop enta bele, e go shit-am kom out? "Bot di tins wey dey kom out from pesin mout, dey kom from en heart and na dis tins dey mak di pesin dirti."Na from pesin heart bad-bad tins dey kom out and dis tins dey mak dem kil, slip wit hu dem nor mari, tif, lai and to joj pesin for en bak."Na all dis tins dey mak pesin dirti, nor bi bikos pesin chop wit en hand
0 likes · 0 comments · 0 shares