Post by Okediadi Emeka (@emekoked)
21 Ivun doh dem no sey God dey, dem nor dey gri gi-am glori as God. Dem nor dey tank am for all di tins wey E dey du. Insted, na nonsense tins dem dey du and dia wiked maind nor fit undastand di trut again. 22 Ivun doh dem tink sey dem wise, dem bi fools; 23 bikos insted mak dem woship God wey dey hevun, dem kon dey woship image wey dem mold or karve laik pesin, bird, anima or snake
0 likes · 0 comments · 0 shares