Post by Okediadi Emeka (@emekoked)

18 Bikos of all di sins and bad tins wey wiked pipol dey du, God vesnashon dey show from hevun and di sins dey kova di trut. 19 So God kon ponish dem, since dem no evritin wey dem sopoz to no abaut God, bikos na-im show dem. 20 From di taim wen God kreate di wold, E don show us di tins wey odinari eye nor dey fit si; en pawa and life, tru di tins wey E kreate. So wiked pipol nor get eskuze at-all.

18 Bikos of all di sins and bad tins wey wiked pipol dey du, God vesnashon dey show from hevun and d...

0 likes · 0 comments · 0 shares