Post by Okediadi Emeka (@emekoked)
8So, God nor go kondem pipol wey biliv Jisos Kraist. 2 Since di Holi Spirit don giv una life wey kom from Jisos Kraist, e go fri una from sin and deat. 3 Mosis law nor fit du dis tins, bikos di yeye life wey wi dey liv don mak di law wik. Bot God don fri us wen E send en pikin kom laik humanbin wey bi sina, mak e for sakrifais ensef for awa sins. 4 God du so, so dat wetin di law tok, go hapun wen wi obey di Spirit, insted of awa own maind.
0 likes · 0 comments · 0 shares