Post by Okediadi Emeka (@emekoked)

Mak una nor kos pipol wey dey opres una, bot mak una pray mak God bless dem. 15 Wen pipol dey hapi, mak una folo dem hapi and wen dem dey krai, mak una folo dem krai tu. 16 Mak una trai to bi frend wit evribodi. Mak una nor kari bodi up kon feel sey una wise pas evribodi, insted, mak una dey mak frend wit doz wey nor dey important. 17 Mak una nor pay evil for evil, bot mak sure sey wetin una dey du, gud for God and pipol eye 18 and mak una trai to liv for peace wit evribodi.

Mak una nor kos pipol wey dey opres una, bot mak una pray mak God bless dem. 15 Wen pipol dey hapi,...

0 likes · 0 comments · 0 shares