Post by Okediadi Emeka (@emekoked)
9 Mak wi luv ish oda wel-wel. Mak una hate enitin wey dey bad, bot una must luv enitin wey get trut. 10 Mak una luv ish oda laik brodas and sistas and mak una respet oda pipol pas unasef. 11 Mak una nor taya, bot wit di Holi Spirit help, mak una serv God wit beta maind. 12 Mak una let una hope giv una hapines. Mak una dey patient wen trobol kom and nor stop to pray. 13 Mak una giv fud to God pipol wey dey hungri and mak una dey welkom dem for una haus. 14 Mak una nor kos pipol wey dey opres una,
0 likes · 0 comments · 0 shares