Post by Grant Allen Asiboje (@salaryalert)
John 3:16-18 Pidgin English Bible
16 “God love di pipol wey dey dis world well-well, so E kon send di only pikin wey E get to us, so dat anybody wey bilive am, nor go die, but e go get life wey nor dey end.
17 God nor send en pikin kom kondemn di pipol wey dey inside di world, but make e kom save dem.
18 Anybody wey bilive am, God nor go kondemn am. But di pesin wey nor bilive am, God don kondemn am already, bikos di pesin nor bilive God Pikin name.
0 likes · 0 comments · 0 shares